Enter your email address:

Delivered by FeedBurner

Subscribe in a reader
Biafra Day: How Nigerian south-east states observe 'sit-at-home order' on Biafra Remembrance Day 2021


Situation report wey dey come from Umuahia, di capital of Abia State be say pipo obey di stay for your house alias sit at home order.

Reports dey reach BBC Pidgin domot say tension don rise across South-Eastern Nigeria sake of di May 30 Biafra day.

Di Biafra remembrance na di day dem dey take observe respect to di pipo wey die for di Nigerian Civil War.

Di war start afta di then Govnor of Eastern Region declare a breakaway of di mainly Igbo speaking part of Nigeria on May 30, 1967 to form 'Biafra Land'.

Na Indigenous People of Biafra (IPOB) group, wey goment don proscribe dey champion di remembrance.

Di group bin cut warning for pipo to remain indoors on Monday May 31, 2021 sake of for dia own safety.

But di Nigeria police don assure residents of safety say dem fit dey go about dia normal business.

 

 

Biafra Remembrance Day 2021 - Fotos

"Biafra Day" [Nigeria Biafra Remembrance Day 2021]: Igboland memorial 'Sit-at-home order'
Wetin we call dis foto,

Popular Aroma Junction Awka Anambra State

Anambra State - Biafra Remembrance Day 2021

Di security situation inside Awka Anambra State capital dey tight.

Joint Patrol team of Police/Army/DSS tanda for Strategic locations.

We tori pesin bin see some pesins dey move about freely.

For one of our interview, one man say im gon to bank to make withdraw. Odas say dem dey go hospital to visit dia loved ones.

"Biafra Day" [Nigeria Biafra Remembrance Day 2021]: Igboland memorial 'Sit-at-home order'

Aba [Abia State] - Biafra Remembrance Day 2021

Aba, di commercial centre of Abia state dey relatively calm on Monday morning but majority of di streets dey quiet.

Checks around town show major business outlets along di major roads for Aba dey closed.

However, few shops within streets open partially for business.

We tori pesin see a some pikins dey play football along di roads.

Abia State Govnor Okezie Ikpeazu say goment no oppose di choice of traders locking up dia shops in compliance to the sit at home order given by the leader of the IPOB.

"Biafra Day" [Nigeria Biafra Remembrance Day 2021]: Igboland memorial 'Sit-at-home order'
Wetin we call dis foto,

Checks around town show major business outlets along di major roads for Aba dey closed.

Umuahia [Abia State] - Biafra Remembrance Day 2021

Situation report wey dey come from Umuahia, di capital of Abia State be say pipo obey di stay for your house alias sit at home order.

Our tori pesin dey report say na few motors and commercial tricycles dey move for streets on Monday.

Almost all commercial activities for Umuahia dey on hold as banks no open, schools sef follow obey.

Essential workers wey suppose dey duty no see vehicle carry dem, na waka dem trek go dia place of work.

Tori be say everywia dey calm for now as security pipo full ground for FMC junction and oda areas.

Biafra Day: "Biafra Remembrance Day 2021" Igboland memorial May 31 'sit-at-home order'
"Biafra Day" [Nigeria Biafra Remembrance Day 2021]: Igboland memorial 'Sit-at-home order'
Wetin we call dis foto,

Health Centre Road, Umuahia

Biafra Day: "Biafra Remembrance Day 2021" May 31 'IPOB sit-at-home order for Igboland

Owerri [Imo State] - Biafra Remembrance Day 2021

Na empty streets dey di city of Owerri, wey be di Imo State capital.

Reports wey BBC Pidgin gather show full compliance.

Biafra Day: "Biafra Remembrance Day 2021" Igboland memorial May 31 'sit-at-home order'
Wetin we call dis foto,

Federal polytechnic Nekede/Ihiagwa Futo road

Biafra Day: "Biafra Remembrance Day 2021" Igboland memorial May 31 'sit-at-home order'

Wia dis foto come from, Obum Ejiogu

Wetin we call dis foto,

Erekwerenwa street

Biafra Day: "Biafra Remembrance Day 2021" Igboland memorial May 31 'sit-at-home order'

Wia dis foto come from, Obum Ejiogu

Port Harcourt [Rivers State] - Biafra Remembrance Day 2021

'IPOB sit-at-home order' flop for Port Harcourt wey be di heart of Niger Delta region for di south south.

Instead, di Rivers State goment choose 31 May, 2021 as di demolition day for one auto spare part market for Ikoku.

Di Ikoku market na mainly Igbo traders dey do business there.

Di Rivers State Commissioner for Works, Eloka Tasie Amadi, tell BBC Pidgin say dem never begin demolish di buildings.

But na di landlords dem na im dey go comot some parts wey dem feel say dey valuable. Tasie-Amadi tok.

Di commissioner say na on Tuesday June, 1 dem go begin dei actually demolition for buildings wey dem bin don mark and pay compensation.

Biafra Day: "Biafra Remembrance Day 2021" Igboland memorial May 31 'sit-at-home order'
Wetin we call dis foto,

Traders for di popular Ikoku Motor Spare parts market for Port Harcourt don begin wonder wia dem go comot go kontinue dia business as demolition don dey start to pave way for di flyover project wey di Rivers State Goment wan build for di area.

Biafra Day: "Biafra Remembrance Day 2021" Igboland memorial May 31 'sit-at-home order'
Wetin we call dis foto,

Wen BBC Pidgin visit di area, we find out say all fi shops dey shut down and dem don de-roof some buildings and some pipo don dey collect some valuable parts of di building before di demolition work go begin proper.

Biafra Day: "Biafra Remembrance Day 2021" Igboland memorial May 31 'sit-at-home order'
Wetin we call dis foto,

Wen BBC Pidgin visit di area, we find out say all di shops dey shut down and dem don de-roof some buildings and some pipo don dey collect some valuable parts of di building before di demolition work go begin proper.

 

Post a Comment

Previous Post Next Post