Nigeria ban land afta Twitter remove Buhari tweet
Twitter and join body of licensed Telecommunications Operators don reply Nigeria Federal goment ban on di micro blogging site.
Twitter say Friday announcement from di Information Minister Lai Mohammed dey "deeply concerning".
"We dey investigate and go provide updates wen we know more." Di internet company, wey Jack Dorsey be oga, write for dia reply.
Earlier di global policy team of di social networking site, Twitter Public Policy [@Policy] tweet ontop di mata say:
"We dey deeply concerned by di blocking of Twitter in Nigeria. Access to di free and #OpenInternet na one very important alias essential human right in modern society.
"Twitter Public Policy add say dem go work to restore access for all those in Nigeria wey dey rely on Twitter to communicate and connect with di world.
Access to Twitter from Nigeria main phone providers don dey blocked, according to reports from Lagos and di capital, Abuja.
"We go continue to tok to di authorities and pipo wey dey involved and we go follow di order wey Nigeria Communications Commission (NCC) give us."
Na wetin Chairman of di Association of Licenced Telecommunications Operators [ALTON] Gbenga Adebayo tok inside statement.
"We dey committed to support di goment of Federal Republic of Nigeria and we go uphold di rights of di citizens." Adebayo add.
Kontris wey don ban Twitter & how citizens dia dey tweet
FG suspend Twitter operations for Nigeria
Nigerian Twitter ban and VPN: Twitter micro blogging site, local ISPs reply FG #TwitterBan
WIA DIS FOTO COME FROM,JACK DORSEY
Wetin we call dis foto,
Twitter CEO Jack Dorsey wit staff of one tech company Andela for Lagos Nigeria wen e visit di west African nation in November 2019
Right now many users across di west African nation dey struggle to access di micro blogging site after di goment suspension.
Latest tori be say phone companies like Airtel and MTN don receive order told to block Twitter site.
On June 4 2021, federal goment announce di suspension of operations of Twitter social networking service for Nigeria, indefinitely.
President Muhammadu Buhari administration say di organisation undermine Nigeria goment.
But some pipo still dey access di site for some wi-fi networks.
Skip Twitter post, 1
⚠️ Confirmed: Network data show Twitter is restricted for many users in #Nigeria as of Saturday morning following deletion of President's Tweet, as government declares the platform can undermine "Nigeria’s corporate existence" #TwitterbaninNigeria
📰 https://t.co/3WahgWmaCk pic.twitter.com/MSSet5Yl7O
— NetBlocks (@netblocks) June 5, 2021
End of Twitter post, 1
Meanwhile di Internet service providers also say dem go support di position of United Nations to respect and protect di rights of everybody to communicate.
Dem express support for pipo to share informate freely and to enjoy privacy and security regarding dia data and use of digital communication.
As tins be so Nigeria don join di list of oda kontries for di world like China wey don ban Twitter for dia kontri.
Nigerian Twitter ban and VPN: Twitter micro blogging site, local ISPs reply FG #TwitterBan
WIA DIS FOTO COME FROM,GETTY IMAGES
Wetin we call dis foto,
Twitter na American microblogging and social networking service wia users post and interact wit messages wey dem dey call "tweets".
Nigeria ban land afta Twitter remove Buhari tweet
Dis move by goment dey came just days afta Twitter remove one tweet by President Muhammadu Buhari wey dem say break dia site rules
Oga Mohammed bin criticise di US social media giant decision to take am down, e call di move "double standards".
Di tweet wey Presido Buhari send on 1 June bin dey refer to di 1967-70 Nigerian Civil War and di kain treatment "those wey dey misbehave today" wit "language wey dem go understand".
Tok-tok pesin for Twitter tok say dat post "break Twitter Rules".
Twitter na American microblogging and social networking service wia users post and interact wit messages wey dem dey call "tweets".
Banky W, Atiku, Saraki, odas react to Nigeria FG ban on Twitter micro-blogging site operations
Nigerian Twitter ban and VPN: Twitter micro blogging site, local ISPs reply FG #TwitterBan
WIA DIS FOTO COME FROM,REUTERS
Wetin we call dis foto,
Twitter Public Policy add say dem go work to restore access for all those in Nigeria wey dey rely on Twitter to communicate and connect with di world.
Reactions don begin dey come in afta Nigeria goment announce di suspension of di operations of tech giant, Twitter for di kontri until further notice.
With hashtags Twitter in Nigeria, Twitter ban, VPNs and Federal goment, many pipo and organizations don enta social media to express dia displeasure on top dis new development.
Wetin Nigerians tok on di Twitter ban
Di British Deputy High Commissioner for Nigeria Gill Atkinson don react to di Twitter ban.
Im say, "All Nigerians get di right to freedom of speech and di responsibility not to misuse that right. Any action wey goment take must dey measured, proportionate and not to suppress basic freedoms."
Nigeria Former Vice President, Atiku Abubakar also tweet say, "Hopefully, dis no go be my last tweet."
Twitter suspension reaction screenshot
WIA DIS FOTO COME FROM,TWITTER SCREENSHOT
Former Nigeria Senate President, Bukola Saraki say - "No sir! Dis no suppose be di response from di president of a nation wey get plenty vibrant youthful population wey for some of dem #Twitter na part of their daily lives and source of dia income and livelihood."
Socio Economic Rights Accountability Project SERAP, say dem go sue Nigerian authorities over di illegal suspension of Twitter in Nigeria.
Di Non-Governmental Organization dey of di view say Nigerians get right to freedom of expression and access to information including online.
Amnesty International reply
Amnesty international don condemn Nigeria goment suspension of Twitter for di kontri. Dem call on di Nigerian authorities immediately to reverse di unlawful suspension and oda plans dem get to gag di media and undermine Nigerians human rights.
"Dis action no follow Nigeria international obligations including di one wey dey under di African Charter on Human and People's Rights and di International Covenant on Civil Political Rights. " Dem tok.
Skip Twitter post, 2
Amnesty International condemns the Nigerian government’s suspension of Twitter @Twitter in #Nigeria🇳🇬 — a social media widely used by Nigerians to exercise their human rights, including their rights to freedom of expression and access to information. #TwitterBan
— Amnesty International Nigeria (@AmnestyNigeria) June 4, 2021
End of Twitter post, 2
Other Nigerians including entertainers from oda kontris don chook mouth for di mata.
Banky W say "dem no fit stop kidnapping, armed robbery and terrorism... yet dem fit seize passports, block bank accounts of peaceful protesters. Try ban crypto currency. Dem ban Twitter. Completely out of touch wit young pipo concerns," e tweet.
Skip Twitter post, 3
Nigerian Government bans Twitter, and announce the ban ON Twitter. You can't make this up. Clueless.
— Banky Wellington (@BankyW) June 4, 2021
Post a Comment