Nigeria-born UFC champion Israel Adesanya don retain im middleweight title afta e defeat Marvin Vettori for UFC 263.
Adesanya defeat Vettori through unanimous decision (50-45, 50-45, 50-45) afta Round 5.
Dis na di second time wey Adesanya go beat Vettori for UFC.
Di two fighters bin first face each oda for April 2018 for Adesanya second fight for UFC. Di Nigerian claim victory dat night via split decision.
Nigeria-born UFC star Adesanya wan become MMA legend
Everything about Israel Adesanya vs Marvin Vettori UFC fight
Vettori start di bout wit aggression and land early takedown, but Adesanya soon settle into im work and dominate di striking exchanges, as im use leg kicks to punish di challenger from distance.
Adesanya bin dey in full control of di match despite di plenty mouth wey Vettori make in di build up to di game.
Vettori try to take Adesanya down against di cage for di end of di fourth round but di Nigerian-born fighter stand im ground as e reply Vettori attempt wit leg kicks.
Israel Adesanya celebrates retaining his middleweight title at UFC 263
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto,
Israel Adesanya want im next title defence to come against former Australia champion Robert Whittaker
After dem officially announce di result, Adesanya dedicate di victory to im teammate Fau Vake, wey be up-and-coming fighter wey die in May from injuries wey im sustain for alleged attack for Auckland, New Zealand.
"I just wan tok say Fau Vake, Fau Vake, Fau Vake, I love you, man... Dis fight I dedicate am to you, Fau," im tok.
During di postfight interview, Adesanya tok say Vettori tell am say im believe say na e win di fight for di Octagon.
Adesanya reveal say e tell Vettori to "keep thinking that, whatever helps you sleep at night."
Dis victory na Adesanya third successful middleweight title defense, im never lose any fight for di middleweight category for UFC.
Post a Comment